Friday 28 October 2016

10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK . 1. You see identical twins, you still dey ask 'na twins be dis'? No bros, na picmix...lol 2. Nepa brings light and everyone in the neighborhood shouts 'up Nepaaa'! My guy ask me, O boy na light be that? No oh, Na Holy Ghost fire! Lol! 3. You see person dey vomit, you still dey ask am 'you no well'? Em well, e just dey practice how to vomit make he for do freedom. 4. You just wake up from sleep; person come ask you "you don wake?" No oh, I come buy bread wey I go chop for dream. 5. You see woman wey born new pikin; u come ask her "madam u don born? " No ohhhh, she buy am for OLX... 6. You greet person "good morning ma" ! She ask, my pikin you don wake???? No ohhhh, I dey sleep walk... . 7. My guy ask me "O boy where u dey?" I tell am say i dey bank, nd him ask me "Wat is happening there?" No Nah new yam festival.. *LMAO* 8. My neighbour sees me opening the gates to drive out and asks me, U dey comot? Not at all... I be the new gateman... 9. I dey watch film… my guy enter come ask me "Guy na film u dey watch? No naa... I dey discuss with Osuofia... 10.U see me dey chop indomie come dey ask me, O boy, na indomie u dey chop so? No ohhhh. Na fried rubber band mixed with thread. As it stands now, abeg l need to ask u one question, no vex abeg. Shey na for Facebook you dey read dis message?? http://goo.gl/xJi3Nd https://goo.gl/xJi3Nd https://goo.gl/xJi3Nd

No comments:

Post a Comment